• Joshua Chapter 21

    Di Cities of Di Levites Baba-God Do Wetin He Promise 43. So Baba-God give Israel all di land wey he swear sey he go give dia papa-papa-papa, and dem claim di land, con start to dey stay for there. 44. Baba-God give dem rest for everi corner, just as he bin swear to dia papa-papa-papa. No single one of dia enemies fit stand for dia front; Baba-God put all dia enemies for dia hand. 45. Out of all di beta-beta promises wey Baba-God promise di pipo of Israel, no single one of dem wey no happun.

  • Joshua Chapter 22

    Di Tribes For Di East Go Back To Dia Land Altar Near Jordan 10. Wen dem reach Geliloth near River Jordan for di land of Cannan, naso di pipo of Reuben and Gad, plus di half-tribe of Manasseh, con build one big altar for there—near di Jordan. 11. So di sons of Israel hear sey di sons of Reuben, Gad, plus di half tribe of Manasseh—don build altar for di border of Cannan, for one area near River Jordan, for di side of di pipo of Israel, 12. And wen di sons of Israel hear wetin happun, all pipo of Israel gada for Shiloh to go fight war against dem.…

Share Pidgin Bible App
×

Support di Pidgin Bible ❤️

Help us print 10,000 copies of di Bible to spread Baba-God word more, for language wey di pipo fit understand. No amount dey too small or big. God bless you as you give.

⭐ Rate Pidgin Bible

We hope say di Pidgin Bible don bless your life.

Abeg give us a 5-Star Review for Google Play Store. Your review go help more people discover Baba-God Word.

⭐ Review Now