• Judges Chapter 9

    Abimelech Di Parable Of Di Trees 7. Wen dem tell Jotham about dis tin, he climb up, on top of Mountain Gerizim and he shout to dem, “Make una listen to me, pipo of Shechem, so dat Baba-God fit listen to una. 8. One day di trees go anoint one king for demsef. Dem tell di olive tree sey, ‘Be awa king.’ 9. But di olive tree ansa dem, ‘Abi make I stop to dey produce ororo wey dem dey use take honor men and gods— so dat dem go make me di chairman of trees?’ 10. “Next, di trees con tell di fig tree sey, ‘Come be awa king.’…

  • Judges Chapter 10

    Tola Jair 3. Afta am, Jair of Gilead—wey lead Israel for twenty-two years. 4. He get thirty sons wey dey ride thirty donkeys. Dem get thirty cities for Gilead wey dem call Havvothjair till today. 5. Wen Jair die, dem bury am for Kamon. Jephthah 6. Di pipo of Israel do evil tin for Baba-God eyes again. Dem serve Baalim plus Ashtaroth, and di gods of Syria, di gods of Sidon, di gods of Moab, di gods of Ammon, plus di gods of di Philistines. Di pipo of Israel fashi Baba-God and dem no gree serve am again. 7. So Baba-God con dey vex for dem. He sell dem put…

Share Pidgin Bible App
×

Support di Pidgin Bible ❤️

Help us print 10,000 copies of di Bible to spread Baba-God word more, for language wey di pipo fit understand. No amount dey too small or big. God bless you as you give.

⭐ Rate Pidgin Bible

We hope say di Pidgin Bible don bless your life.

Abeg give us a 5-Star Review for Google Play Store. Your review go help more people discover Baba-God Word.

⭐ Review Now