• Matthew Chapter 3

    John Di Baptist Clear Road For Jesus 1. Back in di days, John di Baptist con show, he dey preach for inside di desert for Judea, 2. he tok sey, “Make una repent; Baba-God kingdom dey near.” 3. Na me prophet Isaiah tok about wen he tok sey, “One voice dey cry for inside di desert, ‘Clear road for di Oga, make hin way straight.’ ” 4. Na camel hair John use take make hin cloth, wit leather belt for hin waist; na locust and bush honey be hin food. 5. Pipo from Jerusalem, Judea and all di area wey dey round Jordan go meet am. 6. He baptize dem…