-
1st Corinthians Chapter 6
Case Among God-pipo Anyhow-sex 12. “I fit do everitin wey I want,” but no be everitin good for me. “I fit do everitin”—but I no go let anytin master me. 13. “Food na for belle and belle na for food”—but Baba-God go scata di two of dem. Awa body no be for anyhow-sex, but di body na for Christ, and Christ na for di body. 14. And Baba-God go raise us up sef—by hin pawa, just as he raise Oga Jesus up. 15. Abi you no know sey your body na part of Christ hinsef? Abi pesin go con carry Christ body go join wit ashawo? Tufiakwa! 16. Abi you…
-
1st Corinthians Chapter 7
Marriage