• 2nd Corinthians Chapter 12

    Paul Vision Paul Concern For Di Corinthians 11. I don behave like mumu, but na una cos am. Una suppose dey tok sey I don try. No be me be di smallest among all di Apostles wey get levels, even though I be notin. 12. Wen I bin dey wit una, di tins wey confam me as apostle na: full endurance, signs and wonders, plus ogbonge tins. 13. Wetin be di tin wey make una small pass di oda churches, except sey I no be like load to una? Forgive me dis wrong tin! 14. Now I don ready to visit una for di third time, and I no go…

  • 2nd Corinthians Chapter 13

    Last Warnings Las-las Greetings 11. Las-las my pipo, bye- bye. Make una dey perfect, make una cool down wella, make una get one mind, make una live in peace. And di God of love plus peace go dey wit una. 12. Greet each oda wit holy kiss. 13. All God-pipo for here dey send dia greetings. 14. Make di grace of Oga Jesus Christ, plus di love of Baba-God, plus di padi-padi of di Holy Spirit dey wit all of una. Amen.