Proverbs Chapter 15

Abeg share

Soft Ansa Dey Stop Vex

  1. Simple ansa go make pesin wey dey
    vex—cool down, but harsh words dey make
    pesin para.
  2. Wise man tongue sabi use wetin he know
    well-well, but na yama-yama nahin dey pour
    komot for mumu pesin mouth.
  3. Baba-God eyes dey look everi-where, he
    dey watch both good, plus bad pipo.
  4. Soft word na tree of life, but wayo mouth
    dey spoil pesin spirit.
  5. Mumu pipo dey fashi wetin dia papa teach
    dem, but any- pesin wey hear correction get-
    sense.
  6. Good man house brekete wit beta-beta-
    tins, but wicked pipo salary dey bring wahala
    for dem.
  7. Wise man lips dey spread knowledge; but
    mumu pesin heart no-fit spread any beta tin.
  8. Di sacrifice of wicked na tufiakwa for
    Baba-God, but good man prayer dey make
    belle sweet.
  9. Wicked man way na tufiakwa for Baba-
    God, but he love those pipo wey dey follow
    goodness.
  10. Serious punishment dey wait for any-
    pesin wey waka komot from beta way, and
    pesin wey hate correction go kpeme.
  11. Death and scata-scata dey for Baba-God
    front—tokless of men heart!
  12. Mumu pesin hate make pesin dey correct
    am; he no go gree go meet wise man to learn.
  13. Heart wey dey happy dey make face
    shine, but heart wey dey feel sad dey weak
    spirit.
  14. Di heart of man wey get understanding—dey fyne knowledge, but
    yeye nahin mugu dey chop.
  15. All di days of di life of di pipo wey dem
    dey oppress—na evil, but heart wey dey
    happy dey always flex.
  16. E beta make you get small tin con dey
    respect Baba-God, dan make you get plenty
    wealth—wit plenty suffer-head.
  17. E beta make you dey chop vegetables for
    where love dey, dan make you dey chop fat
    malu for where hate dey.
  18. Pesin wey like to vex dey cause fight, but
    jeje man dey make kwanta cool down.
  19. Na shuku-shuku full lazy man way, but
    good man way na express way.
  20. Wise pikin dey make hin papa happy, but
    mumu man dey fashi hin mama.
  21. Yeye dey make ode happy, but man wey get understanding dey go hin own straight way.
  22. Plan dey fail becos beta advice no dey, but
    pesin go succeed wit many advisers.
  23. Man dey happy wen he ansa pesin
    well—and word wey pesin tok for di right
    time dey make-sense well!
  24. Di way of life na up-up for wise man—to
    save am from di grave.
  25. Baba-God go scata di house of pipo wey
    dey feel-big, but he go keep di widow land.
  26. Di tinking of wicked man na tufiakwa for
    Baba-God, but pure words dey sweet.
  27. Man wey get ojukokoro dey carry wahala
    go meet hin family, but pesin wey hate egunje
    (bribe) go live.
  28. Good man heart dey reason wetin he go
    ansa pesin, but wicked man heart dey pour
    evil come out.
  29. Baba-God dey far from evil pipo, but he
    dey hear good pesin prayer.
  30. Pesin wey look happy dey give heart joy,
    and good news dey give good health to di
    bones.
  31. Pesin wey dey listen to di correction of
    life—go dey among wise pipo.
  32. Pesin wey hate teaching—hate hin own
    soul, but any-pesin wey listen to correction
    go gain understanding.
  33. Di fear of Baba-God na di teaching of
    wisdom, and pesin must humble before e get
    promotion.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *