Proverbs Chapter 16
Na Baba-God Dey Give Pesin Wetin To Tok
- Man get plan for hin heart, but na Baba-
God dey give am di correct ansa to tok. - All man way dey pure for hin eyes, but na
Baba-God dey judge hin spirit. - Commit your business to Baba-God, and
your plan go stand gidigbam. - Baba-God don make everitin for
hinsef—even badbelle pipo dey wait to fall
wen kasala go burst. - Any-pesin wey dey feel- big na tufiakwa to
Baba-God, even if dem join dia head togeda,
none of dem go escape wit-out punishment. - Na wit mercy plus faithfulness, pesin
fit pay for sin; and na di fear of Baba-God dey
make man komot from bad tin. - Wen Baba-God love man way, he go make
even hin enemies make peace wit am. - E beta make you get small tin wit clean-
hand, dan to get plenty moni wit ojoro. - Man get plan for hin heart, but na Baba-
God dey tell am where he go waka go. - Oba lips na oracle, and hin lips no
suppose judge wit ojoro. - Baba-God like correct measurement and
balance, all di weight for di bag na hin work. - Na tufiakwa for oba to do wicked tins, na
goodness dey make king-chair stand
gidigbam. - Kings like pesin wey dey tok true; dem
love pipo wey dey tok di right tins. - Wen king vex, e be like messenger of
death, but wise man go cool am down. - Wen king face dey smile, e mean life; and
hin favour be like las-las rain for raining
season. - E beta make you get wisdom—dan make
you get gold, e beta make you choose
understanding—dan make you choose
silver - Di highway of pesin wey get clean-hand
na to komot from evil, any-pesin wey dey
watch hin way, go dey safe. - Afta pesin carry shoulder up, las-las he
go fall, and spirit wey dey feel-big—go soon
fall. - E beta make pesin live simple life wit
low-key pipo, dan to share evil moni wit pipo
wey dey make-mouth. - Any-pesin wey dey hear word—wit
sense, go see alubarika (blessings), and di
pesin wey trust Baba-God go always dey
happy. - Dem know wise pipo for dia
understanding, and beta words dey promote
learning. - Understanding na water of life wey dey
flow to those pipo wey get am, but di
correction of mumu pipo na yeye. - Wise man heart dey guide hin mouth, and
e dey teach am how to sabi tok. - Beta words na honey wey dey sweet for
di soul, and wey dey give good health to di
bone. - Man get hin way, wey be like sey e dey
right for hin eyes, but dat way dey lead to
death las-las. - Pesin wey dey hustle, dey hustle for
hinsef, na hin mouth wey dey hungry dey
ginger am. - Evil man dey plan evil tins, and e dey for
hin lips like faya wey dey burn. - Corrupt man dey cos kwanta, and tatafo dey separate correct padi.
- Man wey like to shed blood dey tempt
hin neighbour, con carry am enta bad way. - He dey close hin eyes to plan bad tin, and
he dey run hin lips—to make evil come to
pass. - White hair na crown of levels, you fit
only get am from beta life. - Pesin wey no dey quick vex beta pass
man wey get pawa; man wey dey control hin
spirit—beta pass man wey fit control full
city. - Dem don throw coin up, but na Baba-
God go decide which side go face up or
down.
Questions about Proverbs 16
What is Proverbs 16 in Pidgin Bible?
This page contains Proverbs 16 in Nigerian Pidgin Bible. Read the passage here: https://pidginbible.com/proverbs-chapter-16/
Where can I read Proverbs 16 in Nigerian Pidgin?
You can read Proverbs 16 in Nigerian Pidgin on Pidgin Bible: https://pidginbible.com/proverbs-chapter-16/
Which Bible book contains Proverbs 16?
Proverbs is the Bible book identified by this reference.
What chapter is Proverbs 16?
The chapter identified by this reference is 16.
Topics connected to this passage
- Love
- Faith
- Hope
- Forgiveness
- Peace
- Wisdom
- Fear
- Healing
- Guidance