Proverbs Chapter 18
Baba-God Name Na Strong Tall-house
- Man wey no dey relate wit pipo—dey do
only wetin dey for hin mind; he no dey gree
for any beta reasoning. - Mumu no like to understand, but dem only
like to tok wetin dey for dia mind. - Wickedness dey bring badbelle, and
shame dey bring disgrace. - Di words from man mouth be like water wey deep well-well, and di well of wisdom be like water wey dey flow.
- E no good to do partiality for wicked pipo,
or make you do ojoro wen you dey judge
man wey get clean-heart. - Mumu pesin mouth dey put am for
wahala, and hin mouth dey invite beating. - Mumu mouth nahin dey make am fall, and
hin lips na trap for hin soul. - Tatafo words be like small food wey dey
enta body. - Pesin wey dey slack for hin business na di
broda of pesin wey dey scata tins. - Baba-God name na strong tall-house,
pipo wey get clean-heart dey run enta
inside—and dem go dey safe. - Rich man wealth na hin strong city; and
dem dey reason am like high wall. - Before man fall, he dey always feel-big
for hin heart, and pesin must humble before
dem go give am respect. - Any-pesin wey ansa pesin before e hear
wetin di pesin wan tok—na mumu and
shame for am. - Man spirit go make am endure wen he
no-well, but who fit carry spirit wey don
taya? - Di heart of pesin wey get-sense dey gada
learning, and wise man ears dey fyne
knowledge. - Pesin gift dey open way for am, and e go
give am connection to bigmen. - Di first pesin wey judge mata dey be like
sey e dey right, until anoda pesin come ask
am question. - To throw coin dey settle mata, and e go
make strong pipo wey wan fight
demsef—dey on dia own lane. - Broda wey dey vex—dey hard to win
pass strong city, and quarrel dey separate
pipo like wen dem lock di gate of strong-
house. - Wetin man dey tok nahin go make am
belleful; di right words wey he tok—dey
make am get yanfu-yanfu. - Di tongue get pawa of life and death, and
those pipo wey love to tok, go chop di fruit of
dia words. - Pesin wey fyne wife don fyne beta tin,
and he go receive favour from Baba-God. - Poor man dey beg for mercy, but bigman
dey ansa am in a rugged way. - Man wey get plenty padi must sabi rub-mind wit pipo, but e get padi wey dey close pass broda.