Proverbs Chapter 17
E Beta Make You Chop Dry Food
Wit Peace
- E beta make pesin use peace chop small
food wey don dry, dan make pesin dey for
house wey dem dey chop belleful—but wit
kwanta. - Wise servant go rule son wey dey bring
disgrace, con share inside di properties
among di brodas. - Na faya dem take dey test as silver or gold
pure reach, but na Baba-God dey test pesin
heart. - Badbelle pipo dey listen to wicked pipo,
and lie-lie pipo like to listen to aproko
tongue. - Pipo wey dey yab poor pipo no dey respect
Baba-God wey make dem; Baba-God must
punish pesin wey dey happy sey kasala don
burst. - Pikin-pikin na crown for pesin wey don
old, and pikin suppose dey proud of hin
papa. - Beta tok no-fit mumu mouth—tokless of
prince wey dey tok lie. - Gift na jazz for di eyes of any-pesin wey
dey give am; he go succeed anywhere he go. - Any-pesin wey cover pesin mistake dey
promote love, but any-pesin wey dey do
tatafo—go separate padi. - If you correct pesin wey get-sense, he go
happy well-well pass make dem blow mumu
hundred times. - Evil man only just wan rebel, so dem go
send wicked messenger against am. - E beta make you jam bear wey dem tiff e
pikin, dan make you meet mugu as e dey show hinsef. - If pesin use evil take pay back good, evil
no go ever komot from hin house. - To start quarrel be like make pesin cos
flood, so drop di kwanta before fight start. - Pesin wey dey support evil, and wey
condemn innocent pipo—both of dem na
tufiakwa to Baba-God. - Why moni dey for mumu pesin hand to
buy wisdom, wen he no ready to learn?
(Moni-miss-road) - Padi dey show love everi time, but dem
born your broda to stand for you wen yawa
gas. - Pesin wey no-get-sense dey do guarantor
for hin neighbour debt. - Pesin wey like sin—love kwanta; pesin
wey trust hin high fence—dey invite scata-
scata. - Man wey get bend-bend heart no-fit
prosper; pesin wey get wayo mouth go enta
one-chance. - To get mumu pikin dey bring pain; no joy
for di papa of mumu pesin. - Heart wey dey jolly—dey do good like
medicine, but spirit wey don taya—dey
make bone dry. - Wicked man dey collect egunje (bribe)
for back—con do ojoro. - Man wey get-sense dey always dey look
wisdom, but mumu pipo eyes dey shuuk
reach di end of di earth. - Mumu pikin dey make dia papa sad, and
dey make dia mama feel pain. - E no good make pesin punish innocent
pesin, or to punish leader becos he do beta
tin. - Man wey know sometin dey hold hin
mouth wen he wan tok, and man of
understanding get jeje spirit. - Pipo go count mugu as pesin wey get-
sense wen he dey quiet, and pipo go tink sey
he dey reason beta tin if he close hin lips.
Questions about Proverbs 17
What is Proverbs 17 in Pidgin Bible?
This page contains Proverbs 17 in Nigerian Pidgin Bible. Read the passage here: https://pidginbible.com/proverbs-chapter-17/
Where can I read Proverbs 17 in Nigerian Pidgin?
You can read Proverbs 17 in Nigerian Pidgin on Pidgin Bible: https://pidginbible.com/proverbs-chapter-17/
Which Bible book contains Proverbs 17?
Proverbs is the Bible book identified by this reference.
What chapter is Proverbs 17?
The chapter identified by this reference is 17.
Topics connected to this passage
- Love
- Faith
- Forgiveness
- Peace
- Wisdom
- Money