Proverbs Chapter 2

Abeg share

Wetin You Go Gain From Wisdom

  1. My pikin, if you hear wetin I dey tok, con
    keep wetin I dey tell you—like beta-beta-tins
    for inside your mind,
  2. so dat you go put your ears for ground for
    wisdom, con move your heart to understand,
  3. chai, and if you cry to knowledge, and you
    raise your voice to understand,
  4. if you fyne am like silver, con fyne am
    well-well like beta-beta-tins wey dem hide,
  5. naso you go take understand how to fear
    Baba-God, and you go sabi di tins wey Baba-
    God wan show you.
  6. Na Baba-God dey give wisdom, and na from hin mouth knowledge and understanding dey from come.
  7. He dey keep beta wisdom for pipo wey get
    clean- heart, and he dey guard pipo wey get
    clean-heart.
  8. He dey guard di way of justice, and he dey
    protect di way of hin holy-pipo.
  9. Naso you go take understand wetin dey
    right, good plus fair—and everi beta way.
  10. Wen wisdom go enta your heart, and your
    spirit dey sweet you to learn,
  11. common sense go protect you, and
    understanding go guard you.
  12. Wisdom go save you from wicked men
    way, and from men wey dia mouth don bend,
  13. from men wey don komot from beta
    way—con dey waka inside dark way.
  14. Dem dey happy to do wrong tins, and
    dem dey celebrate evil tins wey bad pipo dey
    do,
  15. pipo wit kurukere way, and wey dey use
    korni-korni dey do dia tins.
  16. E go save you sef from ashawo, plus
    olosho wey get sweet mouth.
  17. from woman wey don run leave her
    husband wey she marry for young age, con
    fashi di oath wey she make for Baba-God
    front.
  18. Her house dey lead to grave, and her way
    dey lead to death.
  19. No-pesin wey meet her—dey come back,
    or dey follow di road of life again.
  20. So make you follow di way of goodness,
    and follow di right way.
  21. Good pipo go live for di land, and correct
    pipo go dey for di land.
  22. But wicked pipo go cut komot from di
    land, and unfaithful pipo root go cut komot
    from di land.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *