Proverbs Chapter 2
Wetin You Go Gain From Wisdom
- My pikin, if you hear wetin I dey tok, con
keep wetin I dey tell you—like beta-beta-tins
for inside your mind, - so dat you go put your ears for ground for
wisdom, con move your heart to understand, - chai, and if you cry to knowledge, and you
raise your voice to understand, - if you fyne am like silver, con fyne am
well-well like beta-beta-tins wey dem hide, - naso you go take understand how to fear
Baba-God, and you go sabi di tins wey Baba-
God wan show you. - Na Baba-God dey give wisdom, and na from hin mouth knowledge and understanding dey from come.
- He dey keep beta wisdom for pipo wey get
clean- heart, and he dey guard pipo wey get
clean-heart. - He dey guard di way of justice, and he dey
protect di way of hin holy-pipo. - Naso you go take understand wetin dey
right, good plus fair—and everi beta way. - Wen wisdom go enta your heart, and your
spirit dey sweet you to learn, - common sense go protect you, and
understanding go guard you. - Wisdom go save you from wicked men
way, and from men wey dia mouth don bend, - from men wey don komot from beta
way—con dey waka inside dark way. - Dem dey happy to do wrong tins, and
dem dey celebrate evil tins wey bad pipo dey
do, - pipo wit kurukere way, and wey dey use
korni-korni dey do dia tins. - E go save you sef from ashawo, plus
olosho wey get sweet mouth. - from woman wey don run leave her
husband wey she marry for young age, con
fashi di oath wey she make for Baba-God
front. - Her house dey lead to grave, and her way
dey lead to death. - No-pesin wey meet her—dey come back,
or dey follow di road of life again. - So make you follow di way of goodness,
and follow di right way. - Good pipo go live for di land, and correct
pipo go dey for di land. - But wicked pipo go cut komot from di
land, and unfaithful pipo root go cut komot
from di land.
Questions about Proverbs 2
What is Proverbs 2 in Pidgin Bible?
This page contains Proverbs 2 in Nigerian Pidgin Bible. Read the passage here: https://pidginbible.com/proverbs-chapter-2/
Where can I read Proverbs 2 in Nigerian Pidgin?
You can read Proverbs 2 in Nigerian Pidgin on Pidgin Bible: https://pidginbible.com/proverbs-chapter-2/
Which Bible book contains Proverbs 2?
Proverbs is the Bible book identified by this reference.
What chapter is Proverbs 2?
The chapter identified by this reference is 2.
Topics connected to this passage
- Salvation
- Wisdom
- Guidance