Proverbs Chapter 21

Abeg share

Di King Heart Dey For Baba-God Hand

  1. King heart dey for Baba-God hand, he dey direct am go where he like—like river of water.
  2. All man ways dey right to am for hin heart,
    but Baba-God nahin dey judge pesin mind.
  3. Baba-God prefer make pesin do wetin dey
    right and justice, dan make pesin give am
    sacrifice.
  4. Big-eyes, and buga for heart—evil man
    movement na sin.
  5. Di plan of pesin wey serious for business
    go surely bring yanfu-yanfu, but di plan of
    rush-rush pipo—go surely lead to poverty.
  6. Moni wey pesin make wit wuru-wuru
    tongue—na dream wey no dey last for pipo
    wey dey fyne death.
  7. Di blood shed of evil pipo go make dem
    kpeme, becos dem no gree do wetin dey
    right.
  8. Di way of corrupt man na wuru-wuru, but
    as for man wey pure—hin way dey right.
  9. E beta make pesin stay for one corner on
    top of roof, dan make pesin dey for house wit
    woman wey like to quarrel.
  10. Wicked man dey fyne where to do evil;
    hin neighbour no- fit see favour for hin eyes.
  11. Wen dem punish mugu—ordinary pipo
    go learn wisdom, but wen dem teach wise
    man, he dey sabi more.
  12. Baba-God wey good—dey use wisdom
    reason wicked man house, and he go
    overthrow wicked pipo for dia wickedness.
  13. If pesin cover hin ears wen poor man dey
    cry, hinsef go cry and no-pesin go ansa am.
  14. Gift wey dem give pesin codedly dey
    make pesin wey dey vex—pam, and egunje
    wey dem give codedly—dey make pesin
    wey dey vex—calm down.
  15. Good pipo dey happy wen justice
    happun, but all di pipo wey dey do evil tins
    go scata.
  16. Na deadbody go be di padi of man wey
    don komot from di road of understanding.
  17. Pesin wey like faji go be poor man, any-
    pesin wey like wine and sweet tins no go fit
    make kudi [moni, ego].
  18. Dem go use wicked pipo life take bail
    good pipo, and dem go use unfaithful pipo
    life take exchange for pipo wey get clean-
    heart.
  19. E beta make you stay for desert, dan
    make you stay wit woman wey like to dey
    para, and wey like quarrel.
  20. Fine-fine-tins, and ororo brekete for wise
    man house, but mumu man dey waste everitin wey he get.
  21. Pesin wey dey follow goodness plus
    mercy go get life, goodness, plus levels.
  22. Wise man go climb di wall of city of
    strong men [attack dia city], con fall dia
    strong-house wey dem trust.
  23. Pesin wey guard hin mouth and hin
    tongue—go keep hin soul from kasala.
  24. Man wey dey make-
    mouth and man wey dey carry shoulder
    up—“Mumu” nahin name; he dey feel-big,
    and he dey buga.
  25. Lazy man wish nahin go kill am, becos he
    no gree use hin hand hustle.
  26. Hin eyes dey shuuk wit longatrot from
    morning till night, but good man dey give wit
    open heart.
  27. Wicked man sacrifice na
    tufiakwa—tokless of wen he give di
    sacrifice wit bad mind!
  28. Lie-lie witness go kpeme, but pesin wey
    dey listen—go tok well.
  29. Wicked man dey bone- face, but as for
    man wey get clean- heart—he dey stand
    gidigbam for hin business.
  30. No wisdom, no understanding, and no
    idea—wey fit stand against Baba-God.
  31. Dem don arrange horse for di day of war,
    but na Baba-God dey save pesin.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *