Proverbs Chapter 22
Beta Name Beta Pass Moni
- Good name beta pass plenty moni, and
favour beta pass silver plus gold. - Rich and poor pipo get one tin wey
make dem resemble: Na Baba-God make all
of dem. - Man wey get-sense go see danger, and he
go hide hin head, but swegbe go shuuk head
and las-las he go suffer. - To live jeje life, and to fear Baba-
God—nahin dey bring wealth, respect, plus
long life. - Shuku-shuku and trap nahin full wicked
man way, but pesin wey dey guard hin
soul—no go jam all those kain tins. - Train your pikin di way wey e suppose
follow, and wen e don big—e no go fashi dat
way. - Bigman dey rule poor pipo, and pesin wey
dey borrow na servant of di pesin wey e dey
borrow from. - Pesin wey plant evil go harvest evil, and di
pawa of hin vex go scata. - Pipo wey love to give—go get blessings, becos dem dey share dia food wit poor pipo.
- Pursue mugu komot, so dat quarrel go
stop. Eehn…kwanta and insult go end. - Pesin wey love pure heart and wey get
beta words—go be king padi. - Baba-God eyes dey watch over
knowledge, but he dey scata unfaithful pipo
yarnings. - Lazy man go tok sey, “Lion dey for
outside,” or, “Dem go kill me for street!” - Ashawo mouth na deep hole; pesin wey
Baba-God dey vex for—go fall for her
words. - Yeye full small pikin heart, but na
koboko of correction dey pursue di yeye tins
komot. - Pesin wey dey oppress poor pipo to make
moni, and pesin wey dey give rich
pipo—both of dem go poor.
Wise Man Tok [Yarnings] - Turn your ears make you hear wetin wise
pesin dey tok; reason wetin I dey teach you
wit your heart, - e make-sense if you keep dem for your
heart, and make you sabi dem for your lips. - So dat your trust go dey wit Baba-God. I
don teach you today—even yousef. - Abi I neva write beta words for you—wit
advice plus knowledge, - so dat I go make you sabi di sure words of
truth—make you fit ansa pesin wey send
you—wit truth? - No do ojoro for poor pipo, becos dem
poor, no oppress poor pipo for court. - Baba-God go carry dia mata for hin head,
and he go obtain di soul of di pipo wey obtain
dem. - No do padi wit pesin wey sabi vex well-
well, no follow pesin wey sabi para, - or you go soon learn hin ways, con put
your soul inside trap. - No join those pipo wey dey shake hand to
confam agreement as guarantor for anoda
pesin debt. - If you no-fit pay, dem go collect even
your bed wey you dey use sleep. - No shift olden days stone wey your papa-
papa-papa don set as boundary. - Abi you neva see man wey sabi hin
work? Na kings he dey serve, no be gbanjo
men.
Questions about Proverbs 22
What is Proverbs 22 in Pidgin Bible?
This page contains Proverbs 22 in Nigerian Pidgin Bible. Read the passage here: https://pidginbible.com/proverbs-chapter-22/
Where can I read Proverbs 22 in Nigerian Pidgin?
You can read Proverbs 22 in Nigerian Pidgin on Pidgin Bible: https://pidginbible.com/proverbs-chapter-22/
Which Bible book contains Proverbs 22?
Proverbs is the Bible book identified by this reference.
What chapter is Proverbs 22?
The chapter identified by this reference is 22.
Topics connected to this passage
- Love
- Faith
- Wisdom
- Fear
- Money
- Guidance