Proverbs Chapter 22
Beta Name Beta Pass Moni
- Good name beta pass plenty moni, and
favour beta pass silver plus gold. - Rich and poor pipo get one tin wey
make dem resemble: Na Baba-God make all
of dem. - Man wey get-sense go see danger, and he
go hide hin head, but swegbe go shuuk head
and las-las he go suffer. - To live jeje life, and to fear Baba-
God—nahin dey bring wealth, respect, plus
long life. - Shuku-shuku and trap nahin full wicked
man way, but pesin wey dey guard hin
soul—no go jam all those kain tins. - Train your pikin di way wey e suppose
follow, and wen e don big—e no go fashi dat
way. - Bigman dey rule poor pipo, and pesin wey
dey borrow na servant of di pesin wey e dey
borrow from. - Pesin wey plant evil go harvest evil, and di
pawa of hin vex go scata. - Pipo wey love to give—go get blessings, becos dem dey share dia food wit poor pipo.
- Pursue mugu komot, so dat quarrel go
stop. Eehn…kwanta and insult go end. - Pesin wey love pure heart and wey get
beta words—go be king padi. - Baba-God eyes dey watch over
knowledge, but he dey scata unfaithful pipo
yarnings. - Lazy man go tok sey, “Lion dey for
outside,” or, “Dem go kill me for street!” - Ashawo mouth na deep hole; pesin wey
Baba-God dey vex for—go fall for her
words. - Yeye full small pikin heart, but na
koboko of correction dey pursue di yeye tins
komot. - Pesin wey dey oppress poor pipo to make
moni, and pesin wey dey give rich
pipo—both of dem go poor.
Wise Man Tok [Yarnings] - Turn your ears make you hear wetin wise
pesin dey tok; reason wetin I dey teach you
wit your heart, - e make-sense if you keep dem for your
heart, and make you sabi dem for your lips. - So dat your trust go dey wit Baba-God. I
don teach you today—even yousef. - Abi I neva write beta words for you—wit
advice plus knowledge, - so dat I go make you sabi di sure words of
truth—make you fit ansa pesin wey send
you—wit truth? - No do ojoro for poor pipo, becos dem
poor, no oppress poor pipo for court. - Baba-God go carry dia mata for hin head,
and he go obtain di soul of di pipo wey obtain
dem. - No do padi wit pesin wey sabi vex well-
well, no follow pesin wey sabi para, - or you go soon learn hin ways, con put
your soul inside trap. - No join those pipo wey dey shake hand to
confam agreement as guarantor for anoda
pesin debt. - If you no-fit pay, dem go collect even
your bed wey you dey use sleep. - No shift olden days stone wey your papa-
papa-papa don set as boundary. - Abi you neva see man wey sabi hin
work? Na kings he dey serve, no be gbanjo
men.