Proverbs Chapter 3

Abeg share

Trust Baba-God

  1. My son, no fashi wetin I dey teach you, but
    keep di tins wey I tell you for your mind.
  2. Dem go make you live long, dem go make
    you see old age, and dem go give you alafia.
  3. No ever fashi mercy and truth, tie dem join
    your neck, write am for di book of your heart.
  4. Naso you go take get favour and high level
    for Baba-God eyes, plus men eyes.
  5. Trust Baba-God wit all your heart, no
    depend on your own understanding.
  6. Ask Baba-God to guide all your way, and
    he go make your way straight.
  7. For your own eyes, no see yoursef as pesin wey too get- sense; fear Baba-God and komot hand from evil tins.
  8. E go make your body get good health, and
    make your bones strong kakaraka.
  9. Use everitin wey you get take honour
    Baba-God, and wit di first-fruit of your
    harvest.
  10. Naso your store go full brekete, and your
    containers go pour-throway wit fresh wine.
  11. My pikin, no throway- face wen Baba-
    God dey teach you lesson, and no dey vex
    wen Baba-God dey correct you.
  12. Becos Baba-God dey correct pesin wey
    he love, just as papa take dey correct hin pikin
    wey he like well-well.
    Blessings For Di Man Wey Don See
    Wisdom
  13. Man wey don fyne wisdom na happy
    man, and man wey don gain understanding.
  14. Wisdom go pay you pass silver, and she
    go give you gain wey pass fine gold.
  15. She fine pass rubies; inside everitin wey
    you want for dis life-no one beta reach
    wisdom.
  16. Long life dey for her right hand, plenty
    moni, plus respect dey for her left hand.
  17. Her ways fine well- well, and na so-so
    peace full all her way.
  18. She be tree of life for those pipo wey hold
    her tight, and di pipo wey keep her—na
    happy pipo.
  19. Na wisdom Baba-God use build di
    foundation of di earth, and he use
    understanding take set di heaven gidigbam.
  20. Na wit hin knowledge he make di rivers
    flow, and di clouds to pour rain for di earth.
  21. My son, no let beta wisdom and common
    sense komot from your eyes, hold dem tight,
  22. dem go be life to your soul, and dem go be
    like fine necklace for your neck,
  23. Naso you go dey waka for your way wit
    safety, and your leg no go nack sometin wey
    go make you stagger;
  24. You no go fear—any time wen you lie
    down for bed. Your sleep go sweet well-well
    wen you lie down for bed.
  25. No dey fear sey kasala go just burst, or
    dey fear wahala from badbelle pipo wen e
    show.
  26. Na Baba-God go be your full-mind, and
    he no go let anytin catch your leg.
  27. No hide beta tin from those pipo wey
    really need am-wen di pawa dey your hand to
    epp.
  28. No tell your neighbour sey, “Go, make
    you come back, and I go give you
    tomorrow,” wen di tin dey wit you.
  29. No plan bad tin for your neighbour becos
    he feel safe to stay near you.
  30. No kwanta wit pesin for no reason—wen
    di pesin no do anytin bad to you.
  31. No jealous pipo wey dey oppress pipo, or
    copy any of hin way.
  32. Pesin wey hin way no straight na
    tufiakwa to Baba-God, but hin secret
    wisdom dey wit pipo wey get clean-heart.
  33. Baba-God curse dey for wicked man
    house, but Baba-God dey bless good pesin
    house.
  34. Baba-God dey laff pipo wey dey use
    pesin laff, but hin grace dey wit pipo wey dey
    do jeje.
  35. Wise pipo go inherit respect, but na
    shame go be di promotion for mumu pipo.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *