Psalm Chapter 10

Abeg share
  1. Why you dey stand for far-far Baba-God? Why you dey hide your face wen
    yawa gas?
  2. Badbelle dey carry-shoulder-up, dey rassle pipo wey no get power, pipo wey
    don fall for hin evil package.
  3. He dey make-mouth wit di bad tins wey dey hin mind; he dey bless pipo wey
    get longatrot and he hate Baba-God.
  4. Wicked pipo dey carry-shoulder, dey feel too big to fyne Baba-God face; for
    inside all dia mind, dem no get space for Baba-God.
  5. Hin way always full wit prosperity; he dey feel too big and you laws dey far
    from am. He dey laff all hin enemies.
  6. He dey tell hinself sey ‘Notin fit shake me; I go away dey jolly and I no go ever
    get kasala.’
  7. Hin mouth dey full wit curses, lies plus threats; kasala and evil dey under he
    tongue.
  8. Dem dey wait for near di village; naso dem waylay innocent pesin, con kill am,
    dem dey watch codedly for dia maga.
  9. He dey wait like lion wey dey code esef; he dey code, dey wait to catch pipo
    wey no get epp, con drag dem go inside hin net.
  10. He dey nack hin maga for ground, dem dey fall for ground; dem dey fall under
    hin power.
  11. He tell himself sef, “Baba-God don forget, he don cover hin face and he no dey
    see again”
  12. Arise Baba-God, raise your hand up Oh God. No bone pipo wey no get pesin to
    epp dem.
  13. Why di wicked man dey abuse Baba-God? Why he dey tell hinsef sey “Baba-
    God no go ask me any question”?
  14. But you O God dey see wahala and katakata; you reason am con put am for
    your hand. Di pipo wey don wound dey put dia life for your hand; na you dey epp
    pipo wey no get papa.
  15. Break di wicked man and evil man hand; ask am about all di bad tins wey he
    don do, wey pipo no fit know.
  16. Baba-God na king forever and ever; di nations go pkeme comot from hin land.
  17. Oh Lord, you dey hear di wish of those pipo wey get plenty wahala; you dey
    raise dia spirit and you dey listen to dia cry,
  18. you dey defend pipo wey no get palee and pipo wey dey wey dem don match
    for ground, so dat pipo of dis earth no go dey live wit fear again.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *