Psalm Chapter 11
- Na inside Baba-God I dey hide my head. How you fit con tell me sey: ‘Fly like
bird go your mountain. - See, wicked dey arrange dia weapon, dem dey set dia bow and arrow for
darkness to shoot Baba-God pikin for heart. - If di foundation dey pkafuka, wetin Baba-God pikin go do?
- Baba-God dey inside hin holy temple; God dey for hin throne for heaven; He
dey observe man pikin; hin eyes dey look inside dia mind. - Baba-God dey observe di righteous pipo, but hin soul hate wicked pipo and
those pipo wey like fight-fight. - He go pour hot faya and burning sulfur for wicked pipo head; breeze wey go
burn nahin go meet dem. - Baba-God dey righteous, he like justice; men wey dey waka straight go see hin
face.
Questions about Psalm 11
What is Psalm 11 in Pidgin Bible?
This page contains Psalm 11 in Nigerian Pidgin Bible. Read the passage here: https://pidginbible.com/psalm-chapter-11/
Where can I read Psalm 11 in Nigerian Pidgin?
You can read Psalm 11 in Nigerian Pidgin on Pidgin Bible: https://pidginbible.com/psalm-chapter-11/
Which Bible book contains Psalm 11?
Psalm is the Bible book identified by this reference.
What chapter is Psalm 11?
The chapter identified by this reference is 11.