Psalm Chapter 121
Epp Dey Come From Baba-God
- Dis na song of rising. I carry my eyes up go di mountains—where my epp go come from?
2. My epp dey come from Baba-God—wey make heaven plus earth.
3. He no go let your leg shake, pesin wey dey watch you no dey sleep;
4. True-true, pesin wey dey watch Israel no go crash or sleep.
5 . Baba-God dey watch you—Baba-God na your shade for your right hand.
6. Di sun no go wound you for day, or di moon for night.
7. Baba-God go keep you from evil—he go save your soul;
8. Baba-God go keep you wen you dey komot, and wen you dey come back—both now and forever.