Psalm Chapter 123

Abeg share

Dis Na Prayer Of Mercy

  1. Dis na song of rising. Na your face my eyes dey look—you wey your king-chair dey for heaven.

2. As workers take dey look dia oga face, as house-girl take dey look her madam face, naso awa eyes take dey look Baba-God awa Oga—until he sorry-for us.

3. Sorry-for us, chai Baba-God, sorry-for us, becos we don endure as pipo hate us wella.

4. Awa soul burku wit di insult of pipo wey dey buga—and pipo wey dey feel-big hate us well- well.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *