Psalm Chapter 133
Brodas Wey Gum Body
- Dis na song of rising. Of David. See as everitin good, and as everitin segemenge—wen brodas dey stay togeda in unity.
- E be like beta ororo wey dem pour for pesin head—wey dey rush go down for hin bear-bear, wey dey rush go down for Aaron bear- bear, down to di neck of hin cloth.
- E be like wen di dew of Hermon, and like di dew wey dey fall on top di mountains of Zion. Na for there Baba-God promise hin blessings, even life wey dey last forever.