Psalm Chapter 138
Dis Na Prayer Of Tanks-giving
1. I go praise you wit all my heart; I go sing your praises for front of di gods.
2. I go bow down face your holy worship-place, and I go praise your name becos of your soft-love, plus your truth—becos you don give your word levels pass your name.
3. You ansa me wen I call, you make me get full-mind wit pawa inside my soul.
4. Oh Baba-God, all di kings of di earth go praise you, wen dem hear di word from your mouth.
5. Make dem sing about Baba-God way, becos Baba-God levels na ogbonge.
6. Even as Baba-God dey up-up, he dey reason pipo wey dey low- key, but na from far-far he take dey notice pipo wey dey feel big.
7. Even if I waka inside wahala, you dey keep my life; and you stretch your hand against di vex of my enemies, and you use your right hand take save me.
8. Baba-God go make everitin about me dey perfect; Oh Baba-God, you dey sorry-for pesin forever—no fashi your handwork.