Psalm Chapter 137

Abeg share

Di Cry Of Di Prisoners Wey Dey Babylon

  1. Near di rivers of Babylon, na for there we sidon—dey cry, wen we remember Zion.

2. Na for there we hang awa harps for di poplar trees,

3. na for there di pipo wey catch us, ask us sey make we sing for dem, pipo wey dey show us pepper tok sey make we sing song of happiness; dem tok sey, “Make una sing one of di song of Zion—for us!”

4. How we go fit sing Baba-God song for inside foreign land?

5. If I fashi you, oh Jerusalem, make my right hand forget hin skill.

6. If I no remember you, make my tongue gum-join on top of my mouth—if I no see you as wetin dey make my belle sweet me pass.

7. Oh Baba-God, remember wetin di Edomite do di day wey Jerusalem fall. Dem tok sey, “Tear am down, scata am down reach di foundation.

8. Chai, daughters of Babylon wey be born-throway, make Baba-God bless di pipo wey go do una wetin una do us—

9. Make Baba-God bless any- pesin wey go carry una small pikin head nack for rock.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Share Pidgin Bible App
×

Support di Pidgin Bible ❤️

Help us print 10,000 copies of di Bible to spread Baba-God word more, for language wey di pipo fit understand. No amount dey too small or big. God bless you as you give.

⭐ Rate Pidgin Bible

We hope say di Pidgin Bible don bless your life.

Abeg give us a 5-Star Review for Google Play Store. Your review go help more people discover Baba-God Word.

⭐ Review Now