Psalm Chapter 14

Abeg share
  1. Pipo wey no get sense tok sey “Baba-God no dey.” Dem be bad eggs, dia ways
    wicked die; no-pesin dey wey dey do good.
  2. Baba-God look down from heaven to see if pesin still dey wey overstand among
    man pikin dem, if pesin still dey wey dey fyne God.
  3. Everi-pesin dey live dia life, all dia eyes don tear reach ground; nobody dey do
    good again, no single pesin.
  4. Badbelle pipo no go ever learn—those pipo wey dey chop my pikin as men take
    dey chop bread, and wey no dey call Baba-God name?
  5. See dem as dem, as fear don cover dia head, Baba-God dey for where good
    pipo dey.
  6. una wey be wicked pipo dey spoil poor pipo plans, but na Baba-God go hide
    dem.
  7. Oh make salvation for Israel come from Zion! Wen Baba-God go bring back di
    wealth of hin pipo, make hin pikin dem jirate and jubilate.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *