- God who go fit stay for your holy-place? Who fit live for your holy hill?
- Pesin wey dey waka-straigh, and wey dey do di right tin, pesin wey dey tok
truth from hin heart
- and pesin wey no dey tok bad about anoda pesin, wey no dey do wrong tin to
hin neighbor, and pesin wey no dey bad-mouth hin fellow human being,
- pesin wey hate wicked men and respects those pipo wey dey fear God, pesin
wey dey keep hin word even wen e dey hard for am, pesin wey dey borrow moni
without interest, wey no dey accept egunje against innocent person. Pesin wey do
all dis tins no go shake.
Post Views: 45