- Make Baba-God hear you wen wahala show face; make di name of di God of
Jacob protect you.
- Make he send you epp from hin holy-place, con give you support from Zion.
- Make he remember all your scrifce con accept all your burnt offering.
- Make he give you di tins wey you really want from your heart and make all your
plans succeed.
- We go shout wit happiness wen you succeed, con carry awa banner go up in di
name of awa God. Make Baba-God give you everitin wey you dey ask am.
- Now I know sey Baba-God dey save pipo wey he anoint; he dey ansa am from
hin holy heaven wit di power of hin right hand to save.
- Some pipo trust in chariot, and some dey trust in horses, but we go remember
di name of awa God.
- Baba-God bring dem down to dia knees and dem fall, but we go rise up stand
gidigbam.
- Oh Lord, save di king! Ansa us wen we call.
Post Views: 41