Psalm Chapter 20
- Make Baba-God hear you wen wahala show face; make di name of di God of
Jacob protect you. - Make he send you epp from hin holy-place, con give you support from Zion.
- Make he remember all your scrifce con accept all your burnt offering.
- Make he give you di tins wey you really want from your heart and make all your
plans succeed. - We go shout wit happiness wen you succeed, con carry awa banner go up in di
name of awa God. Make Baba-God give you everitin wey you dey ask am. - Now I know sey Baba-God dey save pipo wey he anoint; he dey ansa am from
hin holy heaven wit di power of hin right hand to save. - Some pipo trust in chariot, and some dey trust in horses, but we go remember
di name of awa God. - Baba-God bring dem down to dia knees and dem fall, but we go rise up stand
gidigbam. - Oh Lord, save di king! Ansa us wen we call.
Questions about Psalm 20
What is Psalm 20 in Pidgin Bible?
This page contains Psalm 20 in Nigerian Pidgin Bible. Read the passage here: https://pidginbible.com/psalm-chapter-20/
Where can I read Psalm 20 in Nigerian Pidgin?
You can read Psalm 20 in Nigerian Pidgin on Pidgin Bible: https://pidginbible.com/psalm-chapter-20/
Which Bible book contains Psalm 20?
Psalm is the Bible book identified by this reference.
What chapter is Psalm 20?
The chapter identified by this reference is 20.
Topics connected to this passage
- Faith
- Prayer
- Salvation
- Strength