Psalm Chapter 21
- Oh Baba-God, di King dey happy for your strength. He dey happy well-well
becos you don give am plenty winning! - You don give am wetin he really want and you give am everitin wey hin ask you.
- You welcome am wit rich blessings, you put crown of pure Gold for hin head.
- He ask you for life and you give am—long life forever and ever.
- He glory great becos of di winning wey you give am; you don use beauty and
might take cover am - You don give am everlasting blesings wey sure con make hin boy sweet am
becos hin know sey you dey by hin side. - Even di oba dey trust Baba-God. No shaking for di king becos of Baba-God love
wey no dey fail am. - You go use your hand catch all your enemies; your right hand go gbab your
enemies. - Wen you go show, you go lick dem like a faya wey hot die. God go swallow dem
as he dey pkara and he fire go burn dem. - You go scata dia descendant from di earth, you go comot dia pikin-pikin-pikin
wey dem neva born from di earth. - Dem plan bad tin for you, dem even set trap for you, dem no go fit succeed;
- you go make dem turn dia back wen you shoot dem wit your bow and arrow.
- you get levels, Oh Lord, wit your strength we go sing and praise you power.
Questions about Psalm 21
What is Psalm 21 in Pidgin Bible?
This page contains Psalm 21 in Nigerian Pidgin Bible. Read the passage here: https://pidginbible.com/psalm-chapter-21/
Where can I read Psalm 21 in Nigerian Pidgin?
You can read Psalm 21 in Nigerian Pidgin on Pidgin Bible: https://pidginbible.com/psalm-chapter-21/
Which Bible book contains Psalm 21?
Psalm is the Bible book identified by this reference.
What chapter is Psalm 21?
The chapter identified by this reference is 21.
Topics connected to this passage
- Faith
- Prayer
- Strength
- Money
- Worship