- Baba-God, Baba-God, why you con fashi me liked dis? Why you dey very far to
save me, you far well-well from di cry wey I dey cry for my heart?
- Oh my God, I dey cry for day time but you no ansa me, for night, I no stop to
dey cry.
- But you sidon for throne as di Holy one; na you be the praise of Israel.
- Na inside you our papa-papa-papa put trust; dem trust you and you save dem.
- Dem cry to you and you save dem; na you dem trust and you no dey disappoint
dem.
- But I be worm and I no be man, pipo dey laff me and my pipo dey fashi me.
- All those pipo see me dey yab me; dem sama me wit insult con dey shake dia
head;
- “He trust in Baba-God; make God save am. Make God deliver am, since he like
God well-well.
- But you comot me from inside belle; you make me trut you even wen I dey suck
my malee breast.
- From wen dem born me nahin I dey wit you; na you be my God from inside my
mama belle.
- No dey far from me, yawa wan gas and I no get pesin wey go epp me.
- Plenty nama surround me; strong malu of Bashan don round me.
- Lion wey dey shout dey kill bush-meat open dia mouth wide for me.
- I be like water wey pour and all my bones don comot for my joints. My heart
don turn to wax; e don melt throway inside me.
- My energy don dry like clay, and my tongue don gum ontop of my mouth; you
make me lie down for dust of death.
- Dogs don gather round me; group of badbelle pipo don gather round me, dem
don shuuk my hand and my leg.
- I fit count all my bones; pipo dey look me dey laff.
- Dem share my cloths con cast lot to share my cloth.
- But Baba-God, make you no dey far from me. Chai my strength, come epp me
kiakia.
- Save my life from sword, save my precious life from di power of di dogs.
- Save me from di mouth of di lions; save me from di wild oxen horn.
22.I go yarn my brodas about your name; I go praise you for where your pikin
gather.
- Praise Baba-God you wey dey fear am! All di descendant of Jacob, make una
honour am! Respect am all una descendants of Israel!
- He neva bone or fashi una wey dey suffer; he never hide hin face from am but
he don hear una hin cry for epp.
- Na from you I dey get my inspiration for my praises where your pikin gather; I
go fufil my vow for front of pipo wey dey fear you.
- Poor man go chop belleful; pipo wey dey fyne Baba-God go praise am—make
una heart live forever.
- Everi-pesin wey dey di world go remember con follow God way and all di
families of di Nations go knee down for front of Baba-God,
- na Baba-God get control, nahin dey rule di nations.
- All di rich pipo for di earth go throway party to worship Baba-God, and pipo
wey go down to dust sef go knee down for Baba-God—those pipo wey no fit keep
demsef alive
- Our pikin-pikin-pikin go serve Baba-God. Dem go yarn future Generations
about Baba-God.
- Dem go yarn about hin righteousness, even di pikin wey dem never born now
go tok about God—God don do am.
Post Views: 40