Psalm Chapter 23

Abeg share
  1. Baba-God na my shephard I no go lack.
  2. He make me lie down for where green grass burku, he carry me go where quite water dey,
  3. he dey ginger my soul. He dey guide me for di way righteousness sake of hin name.
  4. Even if I waka pass di valley of di evil forest, I no go fear any evil tin, you dey wit me kamkpe;
    your rod and your staff dey make me sengemenge.
  5. You arrange table for me for front of badbelle pipo. You anoint my head wit ororo and my
    cup full-throway.
  6. Surely, naso goodness and love go dey follow me everi day of my life, and I go dey for inside
    Baba-God house forever.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Share Pidgin Bible App
×

Support di Pidgin Bible ❤️

Help us print 10,000 copies of di Bible to spread Baba-God word more, for language wey di pipo fit understand. No amount dey too small or big. God bless you as you give.

⭐ Rate Pidgin Bible

We hope say di Pidgin Bible don bless your life.

Abeg give us a 5-Star Review for Google Play Store. Your review go help more people discover Baba-God Word.

⭐ Review Now