- Na Baba-God be my light and salvation, who I go com dey fear? Na God be the
Ogidiga of my life—notingo fit make me fear! Baba-God na di strong-house of my
life—who I go con dey fear
- Wen evil men wan change am for me, to chop my flesh, wen my enemies and
badbelle pipo attack me, dem go fall yakata for ground.
- Even though army dey for my front and back, my mind no go cut; even if dem
start war against me, na dat time I go com bigup my chest for dem.
- One tin wey I dey ask from you Baba-God, dis na wetin I dey fine: sey make I
dey inside your house forever, make I fit look di beauty of God and to fine am
inside hin temple.
- He go keep me safe inside hin house wen di day of wahala show; he go hide me
under di roof of hin holy temple, con carry me high ontop rock.
- Naso he go carry my head high pass di enemies wey dey around me; for inside
hin house I go sacrifice as I go dey shout wit joy; I go sing and compose music for
Baba-God.
- Hear my voice wen I call you Baba-God; sorry for me con ansa me.
- My heart dey yarn you sey, “Fyne hin face. Na your face dey fyne so Oh Baba-
God.”
- No hide your face from me, no throway face from your servant becos you dey
vex for am; e don tey wey you don dey epp me. No fashi me or bone me, Oh
Baba-God my Savior.
- Even if my malee and palee fashi me, Baba-God go accept me.
- Teach me you ways Baba-God, lead me inside you straight road becos of di
pipo wey dey oppress.
- No let bad tin wey badbelle pipo want make e happun to me—happun to me.
Pipo wey dey lie for my head don standup against me. Dem want fight me.
- I still dey bigup my chest sey: I go see Baba-God goodness for dis life.
- Wait for Baba-God, make you dey strong con get mind, con wait for Baba-God.
Post Views: 49