Psalm Chapter 28
- Na you I dey call Oh Baba-God my rock. No dey close your ears for me. If you no
gree follow me yarn, I go be like those pipo wey don go down six feet. - Hear my cry for mercy as I dey call you make you epp me. As I raise my hand up
dey face your Most Holy Place. - No drag me comot wit badbelle pipo, wit those pipo wey dey do evil, wey dey
follow dia neighbor tok well but dey carry bad tin for mind. - Repay dem for dia evil handwork, repay dem wit wetin dem don do wit dia
hand, con give dem wetin dem deserve. - As dem no gree show respect for Baba-God handwork, Baba-God go tear dem
down and he no go build dem up again. - Praise be to Baba-God becos he don hear my cry for mercy
- Na Baba-God be my strength and my guard; my heart trust am and he con epp
me. My heart dey jump wit joy and I go sing song take tank am. - Na Baba-God be di streanght of hin pipo, na strong-house wey dey save hin
pipo wey he anoint. - Save your pipo and bless your inheritance; make you be their Shepard wey go
carry dem forever.
Questions about Psalm 28
What is Psalm 28 in Pidgin Bible?
This page contains Psalm 28 in Nigerian Pidgin Bible. Read the passage here: https://pidginbible.com/psalm-chapter-28/
Where can I read Psalm 28 in Nigerian Pidgin?
You can read Psalm 28 in Nigerian Pidgin on Pidgin Bible: https://pidginbible.com/psalm-chapter-28/
Which Bible book contains Psalm 28?
Psalm is the Bible book identified by this reference.
What chapter is Psalm 28?
The chapter identified by this reference is 28.
Topics connected to this passage
- Faith
- Salvation
- Strength
- Worship