Psalm Chapter 28

Abeg share
  1. Na you I dey call Oh Baba-God my rock. No dey close your ears for me. If you no
    gree follow me yarn, I go be like those pipo wey don go down six feet.
  2. Hear my cry for mercy as I dey call you make you epp me. As I raise my hand up
    dey face your Most Holy Place.
  3. No drag me comot wit badbelle pipo, wit those pipo wey dey do evil, wey dey
    follow dia neighbor tok well but dey carry bad tin for mind.
  4. Repay dem for dia evil handwork, repay dem wit wetin dem don do wit dia
    hand, con give dem wetin dem deserve.
  5. As dem no gree show respect for Baba-God handwork, Baba-God go tear dem
    down and he no go build dem up again.
  6. Praise be to Baba-God becos he don hear my cry for mercy
  7. Na Baba-God be my strength and my guard; my heart trust am and he con epp
    me. My heart dey jump wit joy and I go sing song take tank am.
  8. Na Baba-God be di streanght of hin pipo, na strong-house wey dey save hin
    pipo wey he anoint.
  9. Save your pipo and bless your inheritance; make you be their Shepard wey go
    carry dem forever.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *