Psalm Chapter 29
- Make di mighty pipo tok sey Baba-God get glory and strength.
- Give Baba-God di glory wey fit hin name; worship Baba-God inside di beauty of
hin Holliness. - Baba-God voice dey ontop of waters; di God of glory dey halla like thunder,
Baba-God dey halla like thunder ontp di ocean. - Baba-God voice get power well-well, God voice dey royal.
- Baba-God voice fit break strong wood; Baba-God go break into pieces, di cedar
of Lebanon. - He go make Lebanon skip like nama pikin, and Sirion like young ox wey wild.
- Baba-God voice dey strike wit flash of lightening.
- Baba-God voice dey shake di desert; God dey shake di desert of Kadesh.
- Baba-God voice dey twist oaks, and hin voice fit fall all di tree for inside bush.
And for inside hin temple everi-pesin go sing, “Glory!” - Baba-God sidon for throne ontop of water; God dey for the throne as king
forever. - Baba-God dey give hin pipo strength; God dey bless hin pipo wit peace.
Questions about Psalm 29
What is Psalm 29 in Pidgin Bible?
This page contains Psalm 29 in Nigerian Pidgin Bible. Read the passage here: https://pidginbible.com/psalm-chapter-29/
Where can I read Psalm 29 in Nigerian Pidgin?
You can read Psalm 29 in Nigerian Pidgin on Pidgin Bible: https://pidginbible.com/psalm-chapter-29/
Which Bible book contains Psalm 29?
Psalm is the Bible book identified by this reference.
What chapter is Psalm 29?
The chapter identified by this reference is 29.
Topics connected to this passage
- Peace
- Strength
- Worship