Psalm Chapter 30

Abeg share
  1. I go give you levels you Oh Baba-God, na you lift me comot from hole and you
    no let my enemies dey laff me.
  2. O Lord my God, I call you for epp and you epp me.
  3. O Baba-God carry me comot from di grave, you save me from going down six
    feet.
  4. Make all hin holy-pipo sing for Baba-God, praise hin holy name.
  5. Hin vex no dey tey at all, but hin favor dey last forever; cry-cry fit burku for
    night but jolly-jolly must come for morning time.
  6. Wen I dey secure, I tok sey, “I no go ever get shaking.”
  7. O Lord, wen you bin favor me, you make my mountain stand gidigbam; but my
    mind cut wen you troway face comot for my side.
  8. Na you I dey call, Baba-God; God I dey cry to make hin sorry for me;
  9. “Wetin you gain if I pkeme, if I enter six feet? Abi dust fit praise you? Abi dust
    no go fit yarn about your faithfulness?
  10. Hear me O Lord, make you sorry for me; Oh Lord, make you be my epp.”
  11. You don turn my cry-cry to skelewu; you don remove di rag wey bin dey wear
    for body, con wear joy for my body like baffup,
  12. so dat my heart go fit sing for you and I no go dey silent. Oh Baba-God, I go
    give you tanks forever.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *