Psalm Chapter 32

Abeg share
  1. Blessed be na man wey Baba-God don already forgive hin sin, wey hin sins dey
    covered.
  2. Blessed na the man wey Baba-God no dey use hin sisn take judge am and wey
    hin spirit no dey do wayo.
  3. Wen I quiet, my bones come taya becos of di cry wey my heart dey cry
    everiday.
  4. For day and for night, your hand heavy for my body; my energy con waka like
    heat for hot weather.
  5. Naso I con gree sey I don sin and I no hide di bad tins wey I dey do from you. I
    con sey, “I go confess my sins to Baba-God”—and you forgive di shame of sin.
  6. So make everi-pesin wey love Baba-God pray to you wen you dey near; wen
    flood go come, dem to no fit reach where hin dey.
  7. Na inisde you I dey hide my head; na you go protect me from kasala and
    surround me wit songs of deliverance.
  8. I go school you con teach you dey way wey you suppose follow; I go advice you
    and I go watch you.
  9. Make you no be like horse or mule, wey no sabi anytin, wey dem must control
    wit bit and bridle or dem no go come meet you.
  10. Badbelle pipo get plenty wahala but Baba-God love wey no dey fail nahin
    surround those pipo wey trush in name.
  11. Make you happy for Baba-God and make you dey glad, righteous pipo; make
    una sing, and all those wey get clean heart.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *