Psalm Chapter 33
- Make una sing wit joy to Baba-God, righteous pipo; e make sense make pipo
wey get clean hand praise Baba-God. - Praise Baba-God wit harp; compose music for God wit di ten stringed lyre.
- Sing new song to Baba-God; use your skill play music for am and shout wit joy.
- Baba-God word dey right and true; he dey faithful for everitin wey he dey do.
- Baba-God love righteousness and justice; di earth brekete wit hin love wey no
dey ever fail. - Na Baba-God word nahin make di heavens, all di stars na by the breathe of hin
mouth. - Baba-God don gather all di water of di sea inside calabash. He put the deep
inside storehouses. - Make everi-pesin wey dey for dis earth fear Baba-God. Make everi-pesin
respect Baba-God. - He tok and wetin he tok don happen. He order tins and di tins wey he order
happun. - Baba-God dey scata di bad plans of di nations; he dabaru dia idea.
- But Baba-God plan dey stand gidigbam forever, and di idea for hin mind go
stand for all generations. - Blessed na di nation wey make Baba-God dia Oga pkatapkata, di pipo he dey
choose for hin inheritance. - From heaven Baba-God dey look down and see everi man;
- he dey watch all of una for earth from where he dey—
- God wey form everi body heart, wey dey reason everitin wey dem dey do.
- No king dey safe becos of how hin army and weapon plenty reach; no warrior
dey survive by hin own energy. - No waste your time dey believe sey na your horse go save you; even as e get
power reach, e no fit save pesin. - But Baba-God eyes dey watch all those pipo wey dey fear am and those pipo
wey put dia hope inside hin love wey no dey fail, - to save dem from death and keep dem alive wen hungry full town.
- We dey wait for Baba-God wit hope, nahin be my epp and nahin dey guard
me. - Nahin dey make awa heart dey jolly and we trust Baba-God holy name.
- May your love wey no dey fail dey wit us, Oh Baba-God, even as we dey put
awa hope inside you.
Questions about Psalm 33
What is Psalm 33 in Pidgin Bible?
This page contains Psalm 33 in Nigerian Pidgin Bible. Read the passage here: https://pidginbible.com/psalm-chapter-33/
Where can I read Psalm 33 in Nigerian Pidgin?
You can read Psalm 33 in Nigerian Pidgin on Pidgin Bible: https://pidginbible.com/psalm-chapter-33/
Which Bible book contains Psalm 33?
Psalm is the Bible book identified by this reference.
What chapter is Psalm 33?
The chapter identified by this reference is 33.
Topics connected to this passage
- Love
- Faith
- Hope
- Salvation
- Fear
- Worship