Psalm Chapter 32
- Blessed be na man wey Baba-God don already forgive hin sin, wey hin sins dey
covered. - Blessed na the man wey Baba-God no dey use hin sisn take judge am and wey
hin spirit no dey do wayo. - Wen I quiet, my bones come taya becos of di cry wey my heart dey cry
everiday. - For day and for night, your hand heavy for my body; my energy con waka like
heat for hot weather. - Naso I con gree sey I don sin and I no hide di bad tins wey I dey do from you. I
con sey, “I go confess my sins to Baba-God”—and you forgive di shame of sin. - So make everi-pesin wey love Baba-God pray to you wen you dey near; wen
flood go come, dem to no fit reach where hin dey. - Na inisde you I dey hide my head; na you go protect me from kasala and
surround me wit songs of deliverance. - I go school you con teach you dey way wey you suppose follow; I go advice you
and I go watch you. - Make you no be like horse or mule, wey no sabi anytin, wey dem must control
wit bit and bridle or dem no go come meet you. - Badbelle pipo get plenty wahala but Baba-God love wey no dey fail nahin
surround those pipo wey trush in name. - Make you happy for Baba-God and make you dey glad, righteous pipo; make
una sing, and all those wey get clean heart.
Questions about Psalm 32
What is Psalm 32 in Pidgin Bible?
This page contains Psalm 32 in Nigerian Pidgin Bible. Read the passage here: https://pidginbible.com/psalm-chapter-32/
Where can I read Psalm 32 in Nigerian Pidgin?
You can read Psalm 32 in Nigerian Pidgin on Pidgin Bible: https://pidginbible.com/psalm-chapter-32/
Which Bible book contains Psalm 32?
Psalm is the Bible book identified by this reference.
What chapter is Psalm 32?
The chapter identified by this reference is 32.
Topics connected to this passage
- Love
- Prayer
- Forgiveness
- Guidance
- Worship