- I go lift God name up everi time; hin praises go always dey for my lips.
- My soul go make-mouth wit Baba-God; make pipo wey dey suffer hear, con dey
rejoice.
- Follow me give God glory, follow me carry hin name go up.
- I fyne Baba-God and he ansa me; he make fear no catch me again.
- Those pipo wey dey look hin face dey shine; shame no go fit ever cover dia
face.
- Dis poor man call and Baba-God ansa am; he save am from all hin opketu.
- Baba-God angel dey gather round those pipo wey dey fear am and he dey save
dem.
- Make you taste and make you see sey Baba-God good; blessed na di man wey
dey hide hin head for Baba-God side.
- Make all Baba-God holy-pipo fear am. Those pipo wey dey fear Baba-God no
dey lack anytin.
- Lions sef dey taya and hungry fit catch am, but those pipo wey dey fyne Baba-
God no dey lack anytin.
- Come, my pikin, listen to me; I go teach you how to fear God.
- Any of una wey love life and wey like to see many beta days.
- No use your tongue tok bad tin and make your lips no dey tok wetin no be
true.
- Make una change from evil and make una do good; make una try to make
peace and make una fyne am go.
- God eyes dey look righteous pipo and hin ear dey hear dem wey dem cry;
- Baba-God face dey use bad-eye look pipo wey dey do bad-bad tins, to cut dia
memory comot for dis world.
- Righteous man cry out and Baba-God hear am; con save am from all hin
palava.
- God dey close to pipo wey dia heart don break and he go save those pipo wey
dia spirit don weak finish.
- Righeous man fit get plenty wahala but na Baba-God dey save am from all of
dem;
- he go protect all hin bones, and no single one of hin bone go ever break.
- Evil nahin go kill wicked pipo; Baba-God go condemn righteous man enemies.
- Baba-God go redeem hin servant; he no go condemn any-pesin wey hide hin
head for hin side.
Post Views: 61