- Make you listen to my prayer, Oh Baba-God, no bone me as I dey beg;
- hear me make you ansa me. My mind dey wahala me and I dey pkara
- as I dey hear my enemies voice, as I wicked pipo dey look me; dem dey bring
suffer-suffer for my head, dem hate me as dem dey pkara.
- My heart dey cry inside me; di fear of death dey pursue me.
- Fear dey catch me and my body dey shake; gbege don cover me down.
- I con sey, “Chai, I wish sey I get dove wings! I go fly go where I go fit rest—
- I go fly go far-far and go go stay for desert;
- I go rush go petch for one tree, far from di palava and kitikiti.
- Confuse badbelle pipo, Oh God, scata dia tongue, I see fight-fight and beef
inside di city.
- Day and night, dem dey skemp upandan wit bad mind inside di city walls; hate
and abuse full inside am.
- Demon wey dey scata-scata tins dey for di city; threats and lie-lie no fit comot
from di street.
- If enemy dey insult me, I fit endure am, if badbelle wan change am for me, I fit
comot for where dem dey
- But na you, a man like me, my padi, my pesina-pesin,
- wey we bin dey flex together as we dey waka wit pipo enta Baba-God house.
- Make my enemies die by surprise; make dem bury dem alive, evil dey stay for
dia heart like pesin wey dey stay hotel.
- But I dey call you Baba-God, and God save me.
- Evening, morning and afternoon I dey cry taya and Baba-God hear my voice.
- He save me from me without wound from di fight wey pipo dey fight me, even
though plenty pipo dey againt me.
- Baba-God wey dey for throne forever, he go hear dem con put kasala for dia
head, men wey no fit change and wey no dey fear Baba-God.
- My padi dey attack hin pesina-pesin; he don break di promise wey hin make.
- Hin yarnings smooth like butter but na war full hin mind; he yarning sweet like
ororo, but na fight he wan fight.
- Give Baba-God all your wahala and he go make you maintain; he no go ever
let righteous pipo fall.
- But you Oh Baba-God, you go bring down di wicked man inside wuru-wuru pit;
men wey like blood and wey dey do mago-mago no go live half of their life. But as
for me, I go trust you.
Post Views: 55