Psalm Chapter 6

Abeg share
  1. Oh Lord, no yari for me wen you dey vex or correct me wen you dey pkara.
  2. Lord sorry for me, my bone no strong; I be like paper.
  3. My soul dey vex no be small. How long O Lord, how long?
  4. Look my side chai Baba-God and make you deliver me; save my life becos your
    love no dey fail.
  5. No pesin go remember you wen hin don die. Who fit throway-salute for you
    from grave?
  6. I don taya to dey cry inside; throught di night I dey cry river ontop my bed and
    soak my chair wit water from my eyes.
  7. My eyes dey pain me becos of too much cry-cry; dem dey pain me becos of my
    enemies.
  8. Comot for my side badbelle dem, Baba-God don see hear my cry.
  9. Bab-God don hear my cry for mercy; God don hear my prayers.
  10. Shame go catch all my enemies and dem go dey disappointed; dem go turn
    back and shame go catch dem kia-kia.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *