Psalm Chapter 5
- Dey hear my word Oh Oga. Reason my small-small cry.
- Listen to my cry for epp, my Oba and my God, na you I dey pray to.
- For morning, Oh baba, you dey hear my voice; for morning, I dey ask you wetin
dey for me? and I dey wait like woman wey get belle. - You no be God wey like evil tin; badbelle pipo no fit stay for where you dey.
- Pipo wey dey carry-shoulder no fit no fit stand for your front.
- You dabaru those pipo wey dey tok lie. Baba-God hate men wey like blood and
wayo-pipu. - But me, wit your ogbonge mercy, I go enta inside your house; I go use respect
bow down face your holy temple. - Oh Baba-God, show me road inisde your righteousness becos of my
enemies—make your way straight for me. - Pesin no fit trust anytin wey dem yarn; dia heart full wit scat-scata. Dia throat
be like grave wey open down; dem dey yarn wayo wit dia tongue. - Declear sey dem dey guilty, Oh God! Make dia coded bad plan fall dia hand.
Pursue dem comot becops of dia sins wey plenty, becos dem don rebel against
you. - But make all those pipo wey dey hide dia head for your body dey happy; make
dem always dey sing beta song from dia belle. Spread your protection to cover
dem, so dat those pipo wey love your name go happy for you. - You dey bless righteous pipo for sure you dey surround dem wit you favour
like guard.
Questions about Psalm 5
What is Psalm 5 in Pidgin Bible?
This page contains Psalm 5 in Nigerian Pidgin Bible. Read the passage here: https://pidginbible.com/psalm-chapter-5/
Where can I read Psalm 5 in Nigerian Pidgin?
You can read Psalm 5 in Nigerian Pidgin on Pidgin Bible: https://pidginbible.com/psalm-chapter-5/
Which Bible book contains Psalm 5?
Psalm is the Bible book identified by this reference.
What chapter is Psalm 5?
The chapter identified by this reference is 5.
Topics connected to this passage
- Love
- Faith
- Hope
- Prayer
- Guidance
- Worship