- Na only for God body I fit rest put, na Baba-God my salvation dey from come.
- Na on,y him be my rock and salvation; I no go shake becos na Baba-God be my
srong-house.
- How long una go dey fight pesin? all of una wan throway am for ground?—the
leaning wall, dis fense wey dey shake?
- Dem don zero dia mind sey dem must throway am from hin level high; dem like
to lie. Dem go bless you wit dia mouth, but na curse dey dia heart.
- Fyne rest, Oh my soul, inside only Baba-God make you find rest; my hope dey
come from am.
- Na only am be my rock and salvation; he be my strong-house, I no go dey
shake.
- My salvation and my honor dey depend on Baba-God; nahin be my ogbonge
rock and na hin body I dey hide my head put.
- Trust Baba-God everi time, Oh pipo; open your mind for am, na Baba-God body
we dey hide awa head put.
- Ajepkeko just be like breath; ajebuter na scam. If dem sey make dem check dia
weight, dem be notin; dem just be like breath.
- No put your mind to dey collect pipo moni wit gra-gra or dey use property
wey dem fab dey make-mouth; even though you don dey make plenty moni, no
put your mind for your moni.
- Na one tin Baba-God yarn but na two tins I hear; sey you, Oh Baba-God, sey
you strong,
- and sey you, Oh Baba-God, you get love yakata. Surely you go reward everi-
pesin based-on wetin di pesin don do.
Post Views: 44