Psalm Chapter 63

Abeg share
  1. O Baba-God, na you be my God, I dey fyne you seriously; my soul wan drink you
    like water, my body really want you, for land wey dry and for land wey no good,
    where water no dey.
  2. I don see you for inside your holy-place, I don see your power and your glory.
  3. Becos your love beta pass life, my lips go give you levels.
  4. I go praise you as long as I dey alive, and I go lift up my hand for your name.
  5. My soul go bellefull like pesin wey dey chop beta food, my lips go dey sing dey
    praise you.
  6. I go remember you ontop bed; I dey tink of you throughout di night.
  7. Becos na you dey epp me. Na under your wings I for dey sing.
  8. My soul dey hold you thight; your right hand hold me strong.
  9. God go scata those pipo wey dey fyne my life; dem go fall six feeth.
  10. Death go shuuk dem wit hin sword and dem go turn to food for jakals.
  11. But di king go happy for Baba-God; all those pipo wey dey swear wit Baba-God
    name go praise am, as lie-lie pipo mouth go keep quite.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

⭐ Abi you dey enjoy di Pidgin Bible?

If dis app dey bless you, abeg rate us con write small review for Google Play. Your support dey epp more pipo discover Baba-God Word.

★★★★★
Share Pidgin Bible App