Psalm Chapter 62
- Na only for God body I fit rest put, na Baba-God my salvation dey from come.
- Na on,y him be my rock and salvation; I no go shake becos na Baba-God be my
srong-house. - How long una go dey fight pesin? all of una wan throway am for ground?—the
leaning wall, dis fense wey dey shake? - Dem don zero dia mind sey dem must throway am from hin level high; dem like
to lie. Dem go bless you wit dia mouth, but na curse dey dia heart. - Fyne rest, Oh my soul, inside only Baba-God make you find rest; my hope dey
come from am. - Na only am be my rock and salvation; he be my strong-house, I no go dey
shake. - My salvation and my honor dey depend on Baba-God; nahin be my ogbonge
rock and na hin body I dey hide my head put. - Trust Baba-God everi time, Oh pipo; open your mind for am, na Baba-God body
we dey hide awa head put. - Ajepkeko just be like breath; ajebuter na scam. If dem sey make dem check dia
weight, dem be notin; dem just be like breath. - No put your mind to dey collect pipo moni wit gra-gra or dey use property
wey dem fab dey make-mouth; even though you don dey make plenty moni, no
put your mind for your moni. - Na one tin Baba-God yarn but na two tins I hear; sey you, Oh Baba-God, sey
you strong, - and sey you, Oh Baba-God, you get love yakata. Surely you go reward everi-
pesin based-on wetin di pesin don do.
Questions about Psalm 62
What is Psalm 62 in Pidgin Bible?
This page contains Psalm 62 in Nigerian Pidgin Bible. Read the passage here: https://pidginbible.com/psalm-chapter-62/
Where can I read Psalm 62 in Nigerian Pidgin?
You can read Psalm 62 in Nigerian Pidgin on Pidgin Bible: https://pidginbible.com/psalm-chapter-62/
Which Bible book contains Psalm 62?
Psalm is the Bible book identified by this reference.
What chapter is Psalm 62?
The chapter identified by this reference is 62.
Topics connected to this passage
- Love
- Faith
- Hope
- Salvation
- Peace
- Strength