Psalm Chapter 64

Abeg share
  1. Hear me, Oh Baba-God, as I dey voice my complain; protect my life from enemy
    threat.
  2. Hide me from di bad coded tin wey wicked don plan for me, from noise of di
    plenty evil pipo.
  3. Dem dey sharp dia tongue like sword and dem dey throw yarning like sharp
    arrow.
  4. Before innocent man know dem don shoot; dem no even fear, dem just shoot
    am like dat.
  5. Dem they support dia sef for dia bad plan, dem dey tok as dem go take hide dia
    trap; dem sey, “Who go dem?”
  6. Dem plan ojoro dem con sey, “We don get beta plan!” True-true, man mind
    and heart too get wayo.
  7. But Baba-God go shoot dem like arrorws; now-now-now Baba-God go nack
    dem down.
  8. He go use dia mouth put dem for wahala con scata dem finish; everi-pesin wey
    see dem go laff shake head.
  9. Fear go catch everi man, dem go tok about Baba-God handwork con eaon wetin
    hin don do.
  10. Make the righteous pipo happy for Baba-God, and make dem hide dia head
    for Baba-God body; make everi-pesin wey get clean mind praise am!

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *