- Na inside you, Oh Baba-God, na you I dey hide my head put; make shame no
ever catch me.
- Save me and free me I you righteousness; turn your ears to me and save me.
- Be my rock wey I dey hide my head put, place where I go fit always go; give di
command to save me, na you be my rock and strong-house.
- Free me, Oh my God, from wicked pipo hand and from evil plus wicked men
wey wan catch me.
- Na you don be my hope, Oh God wey nobody dey control, na you dey make me
bigup my chest since wey I be youth.
- Since dem born me, na you I dey rely on; you bring me come out from my
mama belle. I go praise you.
- I be like bad sign to plenty pipo, but na you be my strong-house.
- My mouth don full wit your praise, as I dey tok about your beauty from
morning to night.
- No drive me comot wen I don old; no fashi me wen strength no dey for my
body again.
- My enemies dey lie for my head; those pipo wey wan kill me dey plan for my
back.
- Dem sey, “Baba-God don bone am; pursue am make we catch am; no-pesin go
fit save am.”
- No dey far from me, Oh Baba-God; sharply come epp me.
- Make those pipo wey dey lie for my head pkeme wit shame; make shame plus
disgrace catch all those pipo wey wan wound me.
- But as for me, I go always get hope, I go always praise you more-more.
- My mouth go tok about your righteousness and your salvation from morning
to night, even though I no know as e plenty reach.
- I go con yarn about your big-big work, Oh Baba-God wey nobody fit control,
na only your righteousness I go dey tok about.
- Since wey I be small pikin, Oh Baba-God, you don teach me, until until dis day I
go tok about your elele handwork.
- Even wen I don old wit white air full my head, no fashi me, Oh Baba-God, until
I yarn di next generation about your power and your strength to pikin wey dem
never born.
- Your righteousness long from here reach di shy, Oh Baba-God, you wey don
do big-big tins. Who, who be like you, Oh Baba-God?
- You go give me beta life again even though you don make me ee plenty
wahala and katakata. You go bring me up from under ground.
- You go add-join my honor con cool me down again.
- Becos of your faithfulness, I go praise you wit harp, Oh my God; I go sing
praises for you wit lyre, Oh holy one of Israel.
- My lips go shout wit joy wen I sing praise to you—me wey you don save.
- My tongue go tok about your righteous works from morning till night, shame
and katakata don catch those pipo wey wan be wound me.
Post Views: 39