- Make justice brekete for di king hand, Oh Baba-God, di royal pikin wit your
righteousness.
- He go judge your pipo wit righteousness, and he go judge your pipo wey dey
suffer wit justice.
- Di mountain go bring prosperity for di people, di hills go bring di fruit of
righteousness.
- He go defend di pipo wey dey suffer among una con save pipo wey no get shi-
sh—dia pikin. He go match oppressor for ground.
- He go dey as long as the sun dey, as the moon dey tru all generations.
- He go be like rain wey dey fall for farm wey dem don clear, like rain wey dey
water di earth.
- Wen time reach, righteous man go blow, plenty-plenty go dey till di moon fade.
- He go rule from seas to sea and from river to river reach where di earth for end.
- Di tribes for inside di desert go bow down for hin front am, and he enemies go
lick dust.
- Di king of Tashish and kings from abroad go con page homage; the kings of
Sheba and Seba go carry gift con meet am.
- All kings go dobale for am and all nations go serve am.
- He go free pipo wey no get shi-shi wey dey cry out, and pipo wey dey suffer-
suffer—wey no get pesin to epp dem.
- He go sorry for pipo wey no get power and pipo wey no get shi-shi, con save
pipo wey no get shi-shi from death.
- He go save dem from oppression and pipo wey dey fight dem, dia blood dey
precious for hin eyes.
- He go live long! Dem go give am gold from Sheba. Make pipo always dey pray
for am, con dey bless am from morning to night.
- Make food yanfu-yanfu for di land; make e swing ontop of hill. Make hin fruit
yapka like Lebanon; make e grow like grass for field.
- Make he name dey forever; make e continue as long as di sun dey shine. All
nations go dey blessed wit am and dem go call am blessed.
- Praise be to di Lord God, the God of Israel, wey na only am fit do elele tins.
- Praise be to hin glorious name forever; make di whole earth full wit hin glory
Amen and Amen.
- Naso David, wey Jesse pikin take finish hin prayers.
Post Views: 25