Psalm Chapter 73
Di Destiny Of Evil Pipo
- Dis na Psalm of Asaph. True- true, Baba-God dey good to Israel, to those pipo wey get pure heart.
- But as for me, my leg almost dror-fall; my leg almost komot from ground.
- I con dey jealous pipo wey dey make mouth, wen I see as evil pipo take dey prosper.
- Dem no dey suffer any pain wen dem wan kpeme; but dem strong kakaraka.
- Dem no get di kain palava wey pipo get; and dem no dey face di kain yawa wey oda pipo dey face.
- Nahin make to dey make- mouth—be like necklace for dem; dem tie fight-fight for body like wrapper.
- Dia eyes don fat, dem get pass di tins wey dia heart dey wish for.
- Dem dey laff and dem dey tok wit bad mind about oppression, dem dey tok tins wey big pass dem.
- Dem dey bad-mouth heaven, and dia tongue dey waka upandan di earth.
- So Baba-God pipo turn to dem, and dem drink di full cup of dia yarnings.
- Dem tok sey, “How Baba-God go take know? Abi Baba-God know anytin?”
- Naso wicked pipo be—wey dey prosper inside di world, and dem dey make
more moni. - Surely I don keep my heart pure in vain, con wash my innocent hand.
- Suffer full my head from morning till night, and I dey face punishment everi morning.
- If to sey I tok sey, “I for tok like dis,” True-true, I for don betray di generation of una pikin.
- Wen I con try to understand dis tin, di tin pain me well-well,
- until wen I con enta inside Baba-God holy-place; I con understand di destiny of wicked pipo.
- True-true, you don put dem for place wey dem go dror-fall; you scata dem for ground finish.
- See as dem don scata finish—now-now now! Serious yawa don sweep dem komot kpatakpata.
- Like dream wen pesin wake up, so Baba-God wen you wake, you go fashi dem from
your mind. - So my heart con dey cry and my spirit dey vex,
- I bin no-get-sense at all, and I be olodo; I bin dey like animal for your front.
- Upon dat, I still always dey wit you, you hold me wit my right hand.
- You go guide me wit your advice, and las-las you go carry me wit levels.
- Who I get for heaven except you? Notin dey for dis earth wey I wish for—except you.
- My body and my heart fit fail, but na Baba-God be di strength wey dey my heart, and nahin be my own forever.
- True-true, those pipo wey dey far from you—go kpeme; you don scata those wey no dey faithful to you.
- But e dey good for me to carry body near Baba-God. I don put my trust on Baba-God,
so dat I go fit tok about all your handwork.