Psalm Chapter 81
Sing Loud To Baba-God, Wey Be Awa Pawa
- To di Chief producer. On di instrument of Gath, dis na Psalm of Asaph. Make una sing wit loud voice to Baba-God wey be awa strength; raise your voice wit happiness—to di God of Jacob!
- Start di music, shake di sheke-sheke, play di sweet sound of harp plus lyre.
- Blow di trumpet for di New moon; for di full moon—on di day of awa holy Festival.
- Dis one na Baba-God law for Israel, na law of di God of Jacob.
- He don put am as law for Israel wen he move tru-out di land of Egypt, where I hear
language wey we no understand. - “I komot hin shoulder from di load, and hin hands con dey free from carrying basket.
- Una call wen wahala dey for una head, and I save una, I ansa una inside di secret place of thunder; I test una for di water of Meribah.
- “Chai my pipo, make una hear, and I go teach una—if una fit listen to me, Oh Israel!
- Make no foreign gods dey among una; and make una no worship any foreign god.
- Na me be Baba-God una Oga, wey carry una komot from Egypt. Open your mouth
wide, and I go pipo hand. make you belleful. - “But my pipo no go gree hear my voice, and Israel no gree obey me.
- So I con free dem to follow dia stubborn heart—make dem follow dia own plan.
- “If only my pipo go fit listen to me, if Israel fit follow my ways,
- I go sharp-sharp march dia enemies, and I go con use my hand take change-am-for dia
enemies! - Those pipo wey hate Baba-God go pretend to obey am, and dia punishment go
last forever. - But he go feed dem wit di best wheat, and make dem belleful wit honey from rock.”