Psalm Chapter 82

Abeg share

Oghene [Baba-God] Dey In Control

  1. Dis na Psalm of Asaph. Baba-God dey stand among di great ones, and he dey decide
    among di gods.
  2. How long una go dey judge wit ojoro, con show favour to wicked pipo?
  3. Defend pipo wey no get papa and mama; give justice to pipo wey dey inside palava,
    and pipo wey need epp.
  4. Save poor pipo, plus pipo wey need epp; free dem from wicked
  5. “Dem be olodo, dem no understand anytin. Dem dey waka upandan inside darkness; all
    di foundations of di earth dey shake.
  6. I tok sey ‘Una be gods,’ all of una be pikin of Baba-God Most High.
  7. But una go kpeme like men; una go fall like one of di princes.”
  8. Rise up, Oh Baba-God, judge di earth, all di nations belong to you

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Share Pidgin Bible App
×

Support di Pidgin Bible ❤️

Help us print 10,000 copies of di Bible to spread Baba-God word more, for language wey di pipo fit understand. No amount dey too small or big. God bless you as you give.

⭐ Rate Pidgin Bible

We hope say di Pidgin Bible don bless your life.

Abeg give us a 5-Star Review for Google Play Store. Your review go help more people discover Baba-God Word.

⭐ Review Now